Open the app, pick the trailer wey near you, select wetin you wan chop, add to cart, then checkout. E no pass so!
For the app homepage, go see map and the trailer wey dey closest to you. Make sure you On location for your phone.
Account
Go "Settings" inside your account, choose "Change Password," enter new password and save.
Go "Settings" inside your account, choose "Delete Account", and we go know say you no wan do again. But remember say we no fit open account wen you delete again o.
Tap "Forgot Password" on login page, enter your phone number or email, then follow instructions.
Payment
You fit pay with card, USSD, or bank transfer. We no dey collect cash.
Abeg check your account balance or network. If e still fail, contact your bank make dem help you.
Complaints / Missing Microstop
Contact customer support inside the app. Dem go track your order and solve am fast-fast.
Track the trailer to the next microstop. The stops no dey too far from each other. I f you miss all the stops, then go the final destination. The trailer dey spend hours for final destination.